Update: Super Eagles coach wey im name na Jose Peseiro don come out dey tell Nigerians wey dey ask am why e add Ahmed Musa to im Squad to calm down because e get reason why e add am.







Because even  DJ and POS operators don leave their work dey teach certified coach e job.


Oga Peseiro talk this one because some Nigerians dey vex say why e go carry Ahmed Musa wey no get any League goal for e club last season come dey play Afcon qualifiers instead of young strikers wey dey "Halaand" goals for their respective clubs.


The 30 year old player wey im name na  Ahmed Musa don play more than 19 games for e club last season e no score any goal, even Maguire wey be defender get goals and assists pass am but coach no invite Gift Orban and some other Nigerians strikers wey dey score goals up and down.





Oga Peseiro say the reason wey e add Ahmed Musa for the list na because Musa get experience so e need Musa experience for that squad, Musa don play 106 for super Eagles score 16 goals.


 Nigeria go play against Sierra Leone on Sunday if Nigeria just win or draw dem don qualify for Afcon.


My people as Oga coachie add Ahmed Musa instead of other young strikers e good?

Comments

Popular posts from this blog

Tragedy in Edo State: Negligence, Political Agendas, and the Loss of a Valiant Officer

Unmasking the Metamorphosis of Political 'Gangster Writers

Telling the Truth in Nigeria: A Revolutionary Act in a Time of Universal Deceit-Dr Eholor